Saturday, 8 November 2014

AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS by WAP JUNIOR.

NOVEMBER 8TH, 2014. AUCHI POLY HOLIDAY NEWS ===================== GR8 Nigerian Students, GR8 Auchi Polytested & Polytrusted Students! ===================== COPY RIGHT; some persons day copy diz post, afta all the stress to type, yet dem no day put courtesy, iz not fair ooo. ===================== UNA GOOD MORNING! how the holiday dey go?? I don bring anoda ogbonge tori for una on the tinz way dey happen for around campus n beyond. ===================== First and foremost, i wan thank our daddy, sir #Genesis_Newbreeds for him work weldone, daddy na God go bless you the more as you continue the good work way u day do. Because our daddy do waytin NEWSPAPER no go ever do. #Realmatters ===================== I wan congratulate my newly born ND babies... Today na una day do shakara!!! If u no dey go church/mosque lyk dat b4, mak u try go tomorrow go tank baba God noni for ya life. ===================== We promise to serve una beta, Incase you neva check your name for d 3rd batch list, abeg mak u no panic, mak u no worry, as our daddy, sir #Genesis_Newbreeds don mak am easier for all, mak u kindly toggle the Group; #AUCHI_POLY_GROUP_CHAT , u go see all the department list and names... Tank u. ===================== >>>>My Advice for dose way no see deir name for the 3rd batch, small hope stil dey as some list go still show but e go delay, u fit cum for SPAT Programme, d only difference na 3yrs, wile morning na 2yrs, dan writin anoda jamb. ===================== Our News for the day; ===================== >>>>> first: welcome to the month for VASELINE. ===================== >>>>> Report wear KaKI uniform run enta our studio say, INEC VOTERs CARD Registration Don start, as na from next week monday, dem go start 4 dose way nova get b4. For inside d Voter Card FG say e go enable u get work sharply. ===================== >>>>> Report use K-leg enta our studio say, d (UNI ZIK) BSC degree programme Students go resume deir 2nd semester Session next week monday. ===================== >>>>> Report wear Air Max shoe enta our studio say, Regular Student go resume next week monday, but take note, Lecture go start propa as from next year January. ===================== >>>>> Another Report use Shoki dance enta our studio say, Hostel Accomodation go soon start, as na dose way don pay school feez go buy directly from school, wile dose way nova pay fit go buy from hostel portal... ===================== >>>>> Report Tie Rapper run enta our studio say, the list way come out yestaday, na for ND not HND, as HND list go soon fall out. ===================== >>>>> Report carry Ogogoro bottle enta our studio say, our newly born ND babies way see deir name for 3rd batch yestaday, mak una begin fly enta school as from next week cum do una clearance. ===================== >>>>> Report tie headtie enta our studio say, SES don begin Clearance for finalist, as na for some dept, as HND Defendn don commence... ===================== >>>>>If you get home appliance lyk gas cooker, family bed, Tv, home theatre, reading chair and table for sale mak u call me on 08101006164 or inbox me, as buyers day wait. ===================== >>>>>SPAT FORM neva come out, no give ur money to anybody unto help me buy, as d guy go fight ebola for USA, we day expect am to cum diz month. ===================== SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ===================== ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 Compiled by SOCRATE D ManDate ===================== If u get any question way day disturb u for mind, mak u call 08101006164 ===================== Join the Group Chat today no dull ooo get latest updatez 'AUCHI POLY GROUP CHAT https://m.facebook.com/groups/752442511452963 ===================== COPY RIGHT; some persons day copy diz post, afta all the stress to type, yet dem no day put courtesy, iz not fair ooo. ===================== diz na our holiday report, i go day nack una anytin at all way day happen for campus even duh u day far away... Una go day see d report twice a week, i promise to serve una beta. BYE BYE ===================== HAPPY WEEKEND! HAPPY HOLIDAY! Www.auchipolyinfo.blogspot.com

No comments:

Post a Comment