SATURDAY NOVEMBER 22TH, 2014. AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS. ************************** OUR WEBSITE: www.auchipolyinfo.blogspot.com ************************** GR8 Nigerian Students, GR8 Auchi Polytested & Polytrusted Students! ************************** HAPPY WEEKEND! congratulation 2 our newly born babies and our ogas and madams! ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ NEWS REVIEW! ##Na yesterday management release her ND4th and HND2nd batch, diz tym around the names plenty way dem bring, but for ND not all department dem publishd as a result of some dept don occupied, accordin to management more names go stil fall out for HND but no date yet. when i go check namez d population no b here. ##To our newly born babies and our newly ogas and madams , way see deir name for 4th and 2nd batch, how una dey prepare for una clearance? Mak una begin prepare to enta una Department next week mak una come do una clearance as Lectures don start. ##When i post yesterday say, mak people kall me 4dem to check deir name 4notice board, afta everytin some personz juz sit down, quote insult carry text me, e bad to assist? Even 11pm yesterday people stil day kall and text me make i enta school go check deir name for dem. juz 4 dem to send name mak i check, some of dem send moredan 28namez cum, well sha God dey, i go dey for school in the evenin if u neva check ur name mak u kall me by den. ##Na yesterday UNI ZIK do deir matric for school pavilion, campus1, as na 100 pluz studentz dem matriculate, big big dignitriez dey present, as our madam Rector of Auchi poly, talk put for the matter, also the REP VC of Uni zik, we cum hear say as from next year dem go move enta campus2. ##Na since last week here, Regular Students resume deir 2014/2015 1st semester academic session, as students dey scanty for campus, Lectures go begin fully next week, as time table don dey available for all the department from ND1 to HND2. ##Na last week here, management giv departmental bodiez for each school go ahead mak dem begin sell Hostel Space, as Staff hijack the space meant for students,when our crew enta Dean of students affair office, we cum see say students way neva buy at all, plenty pass doze way buy, as na next week Management wan start to allocate the space giv d students. ##Na since last week, Management give d two designatd banks go ahead mak dem start to sell SPAT(SES) Form(ND/HND) for 2014/2015 session, as of last week we recorded bountiful huge some of aspirants way dey troop in to buy the form, WHaT YoU NeEd tO know aBOut SPAT FORM 2014/2015 >>>http://auchipolyinfo.blogspot.in/2014/11/what-you-need-to-know-about-spat-form.html ##To our newly ogas and madams way dey HND1 Microbiology una go dey hold una lectures for Engineering block E5-136, while HN2 go dey large hall(ETF), mak una tak note, also for HND1 Microbiology get ur ogbonge TimeTable mak u call 07067128185 Courtesy- SOCRATE D Mandate ##Na last week here, management finally upload names for both ND and HND well, also dem open portal for online registration, To Check your ND/HND Admission Status here http://www.auchipoly-online.com/checkadmstatus.php and follow the instructions... ##Report reach us say FG don add 2years to our gbasky and lovely Mama, Madam Rector; Dr. Mrs Philipa idogho mak she for take continue her Ogbonge work way she dey do, also her management don try as dem wan turn Auchi Poly to small Obodoyibo wif d beautiful work way dey go on. ##This na a must read for Regular and Spat Studentz, if u knw say, u dey graduate next year, and u no see ur result for diz year, mak u karry ur Online print out karry go MIS,campus1 mak dem for update ur status, if not wen u graduate odaz go day go IT, odaz dey go NYSC u go dey find ur result. ************************** SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 Compiled by SOCRATE D ManDate ************************** ======================== Abeg make una no send me Friend request now, as we get some issue to resolve... If u get any question way day disturb u for mind, mak u call Wap Junior 08101006164 ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ This na our Holiday package, until tomorrow, i go carry anoda ogbonge TORI cum for una. UNA BYE BYE For more TORI mak u run enta AUCHI POLY GROUP CHAT https://m.facebook.com/groups/752442511452963the hottest, latest group on campus... ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ HAVE A BLISSFUL DAY! HAPPY HOLIDAY!
Saturday, 22 November 2014
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
-
We have created a Whatsapp Group Chat for the great students of Auchi Poly, kindly copy link for each of the group you want join, Please not...
-
Hi, Poly Readers, we saw this request in our mailbox this morning…. “Hello Omolove Admin, My name is Dora, I’m a mother of two, I do busines...
-
Welcome to Auchi Poly Blog, the MTN magic sim is now back, fully Loaded. Few people enjoyed the last magic sim that lasted for over a year. ...
No comments:
Post a Comment