Saturday, 23 January 2016

AUCHI POLY 34TH MATRICULATION with WAPJUNIOR- 29TH JANUARY 2016

SATURDAY, 23TH JANUARY 2016 AUCHI POLY LIVE NEWS with #WAPJUNIOR

^

UNA LOVELY MORNING OOO...

¤ Of the Greatest Nigeria Students!! Get our NEWS for BBM: 29121A3B

Phone no. +2348101006164 Get Quick and Latest Update Via: our website

¤

___AUCHI POLY 34TH MATRICULATION with WAPJUNIOR;

|

We all know say Lassa Fever spread pass Rumor? No be news again say

Auchi Poly 34th Matriculation na next week Friday! According to

Management The 2015/2016 Official School Academic Calendar way na

March period dem go do dis year matric....

.

But when de sit down do deir meeting naim de come carry am come front!

Way be January 29th 2016 as dis year matriculation...

.

Reasons behind it---- if una fit recall last year during Auchi Poly

Convocation! I tell una say Madam Rector Dr. Mrs Philipa O. Idogho on

her welcome speech, she talk say her Tenure go expire next year for

Febuary 2016(next month)

.

The Newly Admitted students(Regular/Evening Students) She need to

welcome dem before she comot bkus e no go make sense if the New Rector

welcome dem!!!

.

More Reasons de also! But na dis few ones way I fit reveal to una for the now!!!

.

For the people way de SHOUT like dose Agbero for Ramat park for benin city

•MATRIC no be do or die affair...

•MATRIC na free de no de pay money

•MATRIC no de compulsory, no b him go make you get Distinction(4.00)

for ya GPA...

•WHO MATRIC DON HELP? E help people way don de look for admission for

the past years now!!

.

.

Some students don begin call dier parents for fone say Matric na

15,000naira.... Abeg ooo de no de pay for Matric! Na only d Gown if

you pay for way be 500naira!! For more make you visit your Department

office......

.

.

TeamWapjunior de welcome all the newly admitted students to Auchi poly

as una wan celebrate una matric for next week! Baba God go give una

the strength to finish the race...

.

.

CC @wapjuniorfilms

.

Cc Share Vibrantly......

.

Make I Call my father dem say matric na 10,000naira, me self wan

Matric........ Mama Rashidat on point..

No comments:

Post a Comment