Thursday, 13 November 2014

THURSDAY NOVEMBER 13TH, 2014. AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS

THURSDAY NOVEMBER 13TH, 2014. AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS OUR WEBSITE: www.auchipolyinfo.blogspot.com GR8 Nigerian Students, GR8 Auchi Polytested & Polytrusted Students! COPY RIGHT; some persons day copy diz post, afta all the stress to type, yet dem no day put courtesy, iz not fair ooo. UNA GOOD MORNING! HAPPY MID WEEK! how the holiday dey go?? I don bring anoda ogbonge tori for una on the tinz way dey happen for around campus n beyond. ======================== Regular Students dey start Lecture on the 17th Nov, as Registration don begin 4 una, Hostel Space neva dey available. Also una Orientation na 24th Nov. ======================== Regular 2nd semester result don out. Accordin to students way cum chk, dem say d result mak brain, as HND2,ND2 get good performance, wile ND1,ND2 get higher poor performance. Management cum talk say, dem go try mak SES own day available b4 convocation time. ======================== FG:Madam Rector and her Management don to try, as dem wan turn Auchi Poly to Obodoyibo School. Work dey go on currently for School Hostel. When our crew enta School of ICT , as the builing project wen dey go on, na AC and PlasmaTV dem wan put for each class room. ======================== To all Mass Communicators(SES,ND2)Our Own Daughter, Sister, Aunty: #Sunshine_Anna Mama don Kick bucket, diz na her number 08168245277, abeg mak una call her. ======================== HND Clearance don begin, for my ogas and madams dem, as una knw already, una requirement credentials must be ORIGINAL. Also 2nd Batch stil dey pend to come out, as Management dey use due process for screening of the list. ======================== The SES Students way juz finish exam, una Clearance don begin. ======================== FG don warn our people way dey go do Plastic Surgery make dem stop am, as for China one korean woman, after her surgery, she no fit go bak to her country due to Airport Security scanning machine no recognize her. ======================== FG talk say INEC VOTER'S CARD REG go last for few days. ======================== ======================== ======================== If you get home appliance lyk gas cooker, family bed, Tv, home theatre, reading chair and table for sale mak u call me on 08101006164 or inbox me, as buyers day wait. ======================== SPAT FORM neva come out, no give ur money to anybody unto help me buy, as d guy go fight ebola for USA, we day expect am to cum diz month. ======================== SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 Compiled by SOCRATE D ManDate ======================== If u get any question way day disturb u for mind, mak u call 08101006164 Join the Group Chat today no dull ooo get latest updatez 'AUCHI POLY GROUP CHAT https://m.facebook.com/groups/752442511452963 COPY RIGHT; some persons day copy diz post, afta all the stress to type, yet dem no day put courtesy, iz not fair ooo. This na our Holiday package, until tomorrow, i go carry anoda ogbonge TORI cum for una. HAVE A BLISSFUL DAY! HAPPY HOLIDAY!

No comments:

Post a Comment