Saturday, 22 November 2014

SATURDAY NOVEMBER 22TH, 2014. AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS. ************************** OUR WEBSITE: www.auchipolyinfo.blogspot.com ************************** GR8 Nigerian Students, GR8 Auchi Polytested & Polytrusted Students! ************************** HAPPY WEEKEND! congratulation 2 our newly born babies and our ogas and madams! ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ NEWS REVIEW! ##Na yesterday management release her ND4th and HND2nd batch, diz tym around the names plenty way dem bring, but for ND not all department dem publishd as a result of some dept don occupied, accordin to management more names go stil fall out for HND but no date yet. when i go check namez d population no b here. ##To our newly born babies and our newly ogas and madams , way see deir name for 4th and 2nd batch, how una dey prepare for una clearance? Mak una begin prepare to enta una Department next week mak una come do una clearance as Lectures don start. ##When i post yesterday say, mak people kall me 4dem to check deir name 4notice board, afta everytin some personz juz sit down, quote insult carry text me, e bad to assist? Even 11pm yesterday people stil day kall and text me make i enta school go check deir name for dem. juz 4 dem to send name mak i check, some of dem send moredan 28namez cum, well sha God dey, i go dey for school in the evenin if u neva check ur name mak u kall me by den. ##Na yesterday UNI ZIK do deir matric for school pavilion, campus1, as na 100 pluz studentz dem matriculate, big big dignitriez dey present, as our madam Rector of Auchi poly, talk put for the matter, also the REP VC of Uni zik, we cum hear say as from next year dem go move enta campus2. ##Na since last week here, Regular Students resume deir 2014/2015 1st semester academic session, as students dey scanty for campus, Lectures go begin fully next week, as time table don dey available for all the department from ND1 to HND2. ##Na last week here, management giv departmental bodiez for each school go ahead mak dem begin sell Hostel Space, as Staff hijack the space meant for students,when our crew enta Dean of students affair office, we cum see say students way neva buy at all, plenty pass doze way buy, as na next week Management wan start to allocate the space giv d students. ##Na since last week, Management give d two designatd banks go ahead mak dem start to sell SPAT(SES) Form(ND/HND) for 2014/2015 session, as of last week we recorded bountiful huge some of aspirants way dey troop in to buy the form, WHaT YoU NeEd tO know aBOut SPAT FORM 2014/2015 >>>http://auchipolyinfo.blogspot.in/2014/11/what-you-need-to-know-about-spat-form.html ##To our newly ogas and madams way dey HND1 Microbiology una go dey hold una lectures for Engineering block E5-136, while HN2 go dey large hall(ETF), mak una tak note, also for HND1 Microbiology get ur ogbonge TimeTable mak u call 07067128185 Courtesy- SOCRATE D Mandate ##Na last week here, management finally upload names for both ND and HND well, also dem open portal for online registration, To Check your ND/HND Admission Status here http://www.auchipoly-online.com/checkadmstatus.php and follow the instructions... ##Report reach us say FG don add 2years to our gbasky and lovely Mama, Madam Rector; Dr. Mrs Philipa idogho mak she for take continue her Ogbonge work way she dey do, also her management don try as dem wan turn Auchi Poly to small Obodoyibo wif d beautiful work way dey go on. ##This na a must read for Regular and Spat Studentz, if u knw say, u dey graduate next year, and u no see ur result for diz year, mak u karry ur Online print out karry go MIS,campus1 mak dem for update ur status, if not wen u graduate odaz go day go IT, odaz dey go NYSC u go dey find ur result. ************************** SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 Compiled by SOCRATE D ManDate ************************** ======================== Abeg make una no send me Friend request now, as we get some issue to resolve... If u get any question way day disturb u for mind, mak u call Wap Junior 08101006164 ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ This na our Holiday package, until tomorrow, i go carry anoda ogbonge TORI cum for una. UNA BYE BYE For more TORI mak u run enta AUCHI POLY GROUP CHAT https://m.facebook.com/groups/752442511452963the hottest, latest group on campus... ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ HAVE A BLISSFUL DAY! HAPPY HOLIDAY!

Friday, 21 November 2014

WHaT YoU NeEd tO know aBOut SPAT FORM 2014/2015

<<<>>> ************ ************ SPAT(SES) FORM na N12,150 Bank commission N500 ************ ************ After you don buy the form finish, bank go gv u big envelope way u go put the following inside b4 u submit am.. For doze way day far away mak una no forget to bring No.3, No.5 as e day veri veri important. ************ ************ 1. Print out of duly completed online application form. ************ ************ 2. Two self-addressed envelopes with postage stamp affixed(N200). ************ ************ 3. Photocopy of credentials (SSCE RESULT, JAMB RESULT(optional). ************ ************ 4. Photocopy of payment receipts/teller. ************ ************ 5. Photocopy of Age Declaration/sworn affidavit. ************ ************ 6. Photocopy of Letter of Industrial Work experience(IT) ************ ************ Note. No.6 na 4 dose my ogas and madams way day cum for HND. ************ ************ After you don get all diz, put am inside d big envelope mak u carry am go give dem back. ************ ************ Contact Wap Junior 08101006164 for help.

Breaking News!! ND 4TH AND HND 2ND BATCH IS OUT

The management of Auchi Poly has released it ND 4th and HND 2nd batch is out. Congrats to all those admitted.

Thursday, 20 November 2014

AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS.

FRIDAY NOVEMBER 21TH, 2014. AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS. ************************** OUR WEBSITE: www.auchipolyinfo.blogspot.com ************************** GR8 Nigerian Students, GR8 Auchi Polytested & Polytrusted Students! ************************** COPY RIGHT; some persons day copy diz post, afta all the stress to type, yet dem no day put courtesy, iz not fair ooo. ************************** UNA GOOD MORNING! THANK GO IT' FRIDAY ************************** how the holiday dey go?? I don bring anoda ogbonge tori for una on the tinz way dey happen for around campus n beyond. ======================== The Return of # WAP_JUNIOR coming soon!!! Grab your copy wen e com out.... weekz ago, na im bad people block my facebook account, thinking say i go stop to dey give una the ogbonge TORI , wey dey happen around campus! NA LIE UNA LIE O! Bkus WAP JUNIOR gat alot of tinx to do for una all. ************************** Regular students Lectures has started, try resume... ##################### >=>=>Report use Tecno D5 run enta our studio say, the newly ogas and madams way dey HND1 Microbiology una go dey hold una lectures for Engineering block E5-136, while HN2 go dey large hall(ETF), mak una tak note. >=>=>courtesy- SOCRATE D Mandate ##################### ##################### Today na im b UNI ZIK(Degree Programme) MATRICULATION venue na 4 school pavilion, Campus1... ##################### SPAT 2nd semester result loading... ##################### ND 4th batch list pending... ##################### HND 2nd batch list pending... ##################### Check your ND/HND Admission Status here http://www.auchipoly-online.com/checkadmstatus.php and follow the instructions... ##################### Report use bike run enta our studio say, dem almost rape wan girl yestaday for mechanic site.. Details later.... ##################### SOCRATE say mak i tell una say im belle sweet am well well as dem giv una admission to our newly born babies and our newly ogas and madams and for pipo wey neva get yet, baba God go put una name for 2nd & 4th batch, Diz Ogbonge Tori na from SOCRATE THE MANDATE. ##################### <<<>>> SPAT(SES) FORM na N12,150 Bank commission N500 ##################### After you don buy the form finish, bank go gv u big envelope way u go put the following inside b4 u submit am.. For doze way day far away mak una no forget to bring No.3, No.5 as e day veri veri important. ##################### 1. Print out of duly completed online application form. 2. Two self-addressed envelopes with postage stamp affixed(N200). 3. Photocopy of credentials (SSCE RESULT, JAMB RESULT(optional). 4. Photocopy of payment receipts/teller. 5. Photocopy of Age Declaration/sworn affidavit. 6. Photocopy of Letter of Industrial Work experience(IT) Note. No.6 na 4 dose my ogas and madams way day cum for HND. After you don get all diz, put am inside d big envelope mak u carry am go give dem back. ************************** SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 Compiled by SOCRATE D ManDate ************************** To our newly ogas and madams wey dey HND1 microbiology SOCRATE say im get Ogbonge Awof TimeTable for una, make u ring im number 07067128185 to grab ur own, wile stock last ======================== If u get any question way day disturb u for mind, mak u call 08101006164 ##################### This na our Holiday package, until tomorrow, i go carry anoda ogbonge TORI cum for una. UNA BYE BYE ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ Abeg make una no send Friend request now, as we get some prob to resolve... For more TORI mak u run enta AUCHI POLY GROUP CHAT https://m.facebook.com/groups/752442511452963the hottest, latest group on campus... HAVE A BLISSFUL DAY! HAPPY HOLIDAY!

Wednesday, 19 November 2014

AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS BY #WAP_JUNIOR

THURSDAY NOVEMBER 20TH, 2014. AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS BY #WAP_JUNIOR ************************** OUR WEBSITE: www.auchipolyinfo.blogspot.com ************************** GR8 Nigerian Students, GR8 Auchi Polytested & Polytrusted Students! ************************** COPY RIGHT; some persons day copy diz post, afta all the stress to type, yet dem no day put courtesy, iz not fair ooo. ************************** UNA GOOD MORNING! ************************** how the holiday dey go?? I don bring anoda ogbonge tori for una on the tinz way dey happen for around campus n beyond. ======================== The Return of # WAP_JUNIOR coming soon!!! Grab your copy wen e com out.... Few days ago, na im bad people block my facebook account, thinking say i go stop to dey give una the ogbonge TORI , wey dey happen around campus! NA LIE UNA LIE O! Bkus WAP JUNIOR gat alot of tinx to do for una all. ************************** Abeg mak una small small dey play with my big ogas and madams feelings say 2nd batch don come out, when e cum out i go personal kari una admission cum giv una for houze. Regular Students, diz wan na for my newly born babies(ND), my newly ogas and madams(HND) and dose people way dey b4... Lectures don begin already, TimeTable for some department fall out yesterday, and so today many go still fall out, as Grouping of names dey for road dey cum. Make una try resume. Report use wheelbarrow run enta our studio say, dose way neva check deir ND/HND Admission Status mak u enta here http://www.auchipoly-online.com/checkadmstatus.php SOCRATE say mak i tell una say im belle sweet am well well as dem giv una admission to our newly born babies and our newly ogas and madams and for pipo wey neva get yet, baba God go put una name for 2nd & 4th batch, Diz Ogbonge Tori na from SOCRATE THE MANDATE. <<<>>> SPAT(SES) FORM na N12,150 Bank commission N500 After you don buy the form finish, bank go gv u big envelope way u go put the following inside b4 u submit am.. For doze way day far away mak una no forget to bring No.3, No.5 as e day veri veri important. 1. Print out of duly completed online application form. 2. Two self-addressed envelopes with postage stamp affixed(N200). 3. Photocopy of credentials (SSCE RESULT, JAMB RESULT(optional). 4. Photocopy of payment receipts/teller. 5. Photocopy of Age Declaration/sworn affidavit. 6. Photocopy of Letter of Industrial Work experience(IT) Note. No.6 na 4 dose my ogas and madams way day cum for HND. After you don get all diz, put am inside d big envelope mak u carry am go give dem back. ************************** SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 Compiled by SOCRATE D ManDate ************************** To our newly ogas and madams wey dey HND1 microbiology SOCRATE say im get Ogbonge Awof TimeTable for una, make u ring im number 07067128185 to grab ur own, wile stock last ======================== FOOD FOR THOUGHT From #Elijah_Patrick Gud morning my fellow student u all in should being serious with dis semester result. u all should work had in dis 1st semester oh. because if u play with dis semester e knw gud oh. Auchi poly is sweet skul but don play with dis semester let ur GP high don let it low oh. I beg u all try to read ur books. i am real tak to nd1 student. Thank u all If u get any question way day disturb u for mind, mak u call 08101006164 This na our Holiday package, until tomorrow, i go carry anoda ogbonge TORI cum for una. UNA BYE BYE ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ Abeg make una no send Friend request now, as we get some prob to resolve... For more TORI mak u run enta AUCHI POLY GROUP CHAT https://m.facebook.com/groups/752442511452963the hottest, latest group on campus... HAVE A BLISSFUL DAY! HAPPY HOLIDAY!

AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS BY #WAP_JUNIOR

WEDNESDAY NOVEMBER 19TH, 2014. AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS BY #WAP_JUNIOR ************************** OUR WEBSITE: www.auchipolyinfo.blogspot.com ************************** GR8 Nigerian Students, GR8 Auchi Polytested & Polytrusted Students! ************************** COPY RIGHT; some persons day copy diz post, afta all the stress to type, yet dem no day put courtesy, iz not fair ooo. ************************** UNA GOOD MORNING! ************************** how the holiday dey go?? I don bring anoda ogbonge tori for una on the tinz way dey happen for around campus n beyond. ======================== The Return of # WAP_JUNIOR coming soon!!! Grab your copy wen e com out.... Few days ago, na im bad people block my facebook account, thinking say i go stop to dey give una the ogbonge TORI , wey dey happen around campus! NA LIE UNA LIE O! Bkus WAP JUNIOR gat alot of tinx to do for una all. ************************** Report use power bike run enta our studio say, Regular students don begin lecture, as students no plenty for class... Report use plane fly enta our studio say, online portal don dey open for the regular students... Report use Hummer jeep scata our studio come break our TV say, morning students way no wan resume plently pass doze way don resume... Report use wheelbarrow run enta our studio say, dose way neva check deir ND/HND Admission Status mak u enta here http://www.auchipoly-online.com/checkadmstatus.php Report use eye glass enta our studio say, as lecturez neva even begin well for d regular students, some lecturers don day arrange small small weapon, way dem go tak fall students hand... <<<>>> out of all the plenty banks way dey Auchi, na only two banks school management approve make dem sell the SPAT FORM. when our crew waka enta the various banks way management approve make dem sell the Spat form. When we enta Zenith bank the people way cum buy the form no b here as dem reach 2k plus... As na only two persons from d bank dem appoint make dem sell am... According to one guy way cum purchase the form all d way from lagos, im say'' i have been here for the past hours and haven't purchase the form due to people way dey sell am 2slow... When our oda crew jug enta UBA we come found out say, the bank try as na 3people dey sell am, but u must dey for line, d sun no day help matters... SPAT(SES) FORM na N12,150 Bank commission N500 After you don buy the form finish, bank go gv u big envelope way u go put the following inside b4 u submit am.. For doze way day far away mak una no forget to bring No.3, No.5 as e day veri veri important. 1. Print out of duly completed online application form. 2. Two self-addressed envelopes with postage stamp affixed(N200). 3. Photocopy of credentials (SSCE RESULT, JAMB RESULT(optional). 4. Photocopy of payment receipts/teller. 5. Photocopy of Age Declaration/sworn affidavit. 6. Photocopy of Letter of Industrial Work experience(IT) Note. No.6 na 4 dose my ogas and madams way day cum for HND. After you don get all diz, put am inside d big envelope mak u carry am go give dem back. ************************** SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 Compiled by SOCRATE D ManDate ************************** ======================== If u get any question way day disturb u for mind, mak u call Wap Junior 08101006164 This na our Holiday package, until tomorrow, i go carry anoda ogbonge TORI cum for una. UNA BYE BYE ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ Abeg make una no send Friend request now, as we get some prob to resolve... For more TORI mak u run enta AUCHI POLY GROUP CHAT https://m.facebook.com/groups/752442511452963the hottest, latest group on campus... HAVE A BLISSFUL DAY! HAPPY HOLIDAY!

Tuesday, 18 November 2014

AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS BY #WAP_JUNIOR

TUESDAY NOVEMBER 18TH, 2014. AUCHI POLYTECHNIC HOLIDAY NEWS BY #WAP_JUNIOR ************************** OUR WEBSITE: www.auchipolyinfo.blogspot.com ************************** GR8 Nigerian Students, GR8 Auchi Polytested & Polytrusted Students! ************************** COPY RIGHT; some persons day copy diz post, afta all the stress to type, yet dem no day put courtesy, iz not fair ooo. ************************** UNA GOOD MORNING! ************************** how the holiday dey go?? I don bring anoda ogbonge tori for una on the tinz way dey happen for around campus n beyond. ======================== The Return of # WAP_JUNIOR coming soon!!! Grab your copy wen e com out.... Few days ago, na im bad people block my facebook account, thinking say i go stop to dey give una the ogbonge TORI , wey dey happen around campus! NA LIE UNA LIE O! Bkus WAP JUNIOR gat alot of tinx to do for una all. ************************** REGULAR STUDENT RESUMPTION ! Na yesterday lecture start for Regular Students yesterday. According to one student from school of ICT, im say dem hold class yesterday, as students no plenty for class, due to some dey do clearance and some dey find accomodation. When our crew waka enta School of Art & Design, we see say, some department don start lecture, as one of the student say, dem no dey waste time at all. ************************** ************************** ONLINE REGISTRATION ! Online reg don dey open to all Regular students, and also the Admission letter don dey online, u fit print ur own nw. ************************** ************************** ADMISSION STATUS ! for our ND aspirants way still dey panic, and dey worried about deir admission status. Management don fully upload the ND list well for deir school website, HND own go soon show, kindly run enta http://www.auchipoly-online.com/checkadmstatus.php and put ur JAMB REG and click check admission status. ************************** ************************** HOSTEL PALAVA ! as we post am already yestday... Na yesterday Management approve mak the departmental body for each school and dept begin sell space... As we see am, e nor dey like last year or befor, as people too many way dem admit, and all of dem wan buy the SPACE by all means... Na who get long leg na im go fit get d space, bkuz diz tym around school Hostel na hot cake.... Our Staff no dey help matters at all, as dem hijack the slotz way suppose reach students hand... As some people juz cum buy, dem go sell am at higher price... When our crew interview one student from school of Engr, the babe say she buy the space directly from school 8.5k and when she wan sell am na 50k she go tak sell am, say she no dey force anybody... When our crew waka with leg enta School of Biz, e no reach 30minute all the slotz don finish... We no wan go into am deep, due to waytn happen yesterday, if we begin talk am, we no go fit finish am... According to eyewitnexx n studentz way cum buy space, na 50 slotz dem give All SCHOOL OF APPLIED SCIENCE, a whole school 4 dat matter.... According to people way dey sell d Hostel space, dem say dem fit sell tomorrow... We dey call on the school management make dem do something, as some students way travel from far away to get diz Hostel space at d end of d day, dem no see buy... Dem no fit get dat big money tak go buy frm person hand at higha Price.. That is why the school need the Better Person way God go send cum rescue Auchi Polytechnic so dat all diz MAGO MAGO of hostel space and d rest go stop... We all beg on the school Management make dem try see waytn dem go do, as Staff and Students buy Moredan 1Space, juz to sell am at higher rate.... ************************** ************************** SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ! ND1 and HND1 sch fees »28,000 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 ND2 and HND11 Sch fees»14,200 bank commission 500 Fidelity bank acct no:4150009732 Compiled by SOCRATE D ManDate ************************** ************************** SPAT FORM MATTER ! Spat form still dey on sale, you fit purchase the form for only Auchi, Zenith bank or UBA bank way dey along Otaru road for Auchi. According to management, na CBT dem go use for the screening exercise. While rumour get am say na only screening dem no go do. ************************** ======================== If u get any question way day disturb u for mind, mak u call Wap Junior 08101006164 This na our Holiday package, until tomorrow, i go carry anoda ogbonge TORI cum for una. PACKAGE BY WAP JUNIOR ¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤¤ Abeg make una no send Friend request now, as we get some prob to resolve... For more TORI mak u run enta AUCHI POLY GROUP CHAT https://m.facebook.com/groups/752442511452963the hottest, latest group on campus... HAVE A BLISSFUL DAY! HAPPY HOLIDAY!